Reports

Uniuyo for wahala as ₦906 million revenue disappear, ₦134 million staff pay no get justification

Wahala don land for University of Uyo as auditors don flag over ₦1.04 billion inside di school account wey dem no fit explain well-well. Dis mata wey concern financial record show say di money dey involve cash wey dem no remit to federal government, plus some pagam-pagam payments wey dem give casual workers and honorarium wey dem pay staff without clear reason.

Di main wahala be say, out of total IGR of ₦3.6 billion wey di school generate, dem suppose pay 25 percent to di Federal Government Consolidated Revenue Fund (CRF) as e dey for Treasury Circular TRY/A10&B10/2016. But as we dey talk so, ₦906,355,077.69 remain for ground. Because of dis, auditors don order di school to refund everi kobo of dat money plus interest. If dem fail to do so, di school fit face serious sanction under Financial Regulation 3112(ii).

Apart from dat one, di school record still show another ₦134,255,854.76 wey dem pay anyhow. Out of dis money, ₦129,510,354.76 waka go pay casual workers for five years, but di main yawa be say, nobody see evidence say di money get budget approval before dem spend am. Dis one against Section 27(1) of di Fiscal Responsibility Act 2007.

Come add anoda ₦4,745,500 wey dem give staff as “honorarium” through five different vouchers, but nowhere for paper show wetin dem actually do to deserve dat money. Di auditors don tell dem say if dem no fit explain why dem pay dat money or show justification, dem must return am back to di Treasury.

All dis financial mess happun during di time wey Professor Enefiok Effiong Essien (SAN) dey lead as Vice-Chancellor. Even though dem don alert di school management, dem never talk anything or provide any record to explain why dem no remit di money or why dem pay workers without authorization. Now, auditors don give dem stern warning: return di total ₦1,040,610,932.45 or face heavy penalties according to financial law.

Source: NaijaProbe