One man from Scotland wey dem call Tyler Buchanan don collect six years for prison afta im join hand with one Nigerian, Evans Osiebo, do better hacking business wey loss $11.6 million for United States. De tok say de two men and dia partners follow hack computer systems of plenti company dem and individual pipo, wey lead to di stealing of digital money.
Di U.S. Department of Justice yarn for one statement dis Tuesday say Buchanan, wey be from Dundee, don dey for U.S. custody since April 2025. Di man bin enta court for April 17 and gree say im truly commit conspiracy to do wire fraud and aggravated identity theft. Na Buchanan be the fifth and final person wey dem go jail for dis mata, as im partners don already collect dia own punishment.
Between September 2021 and April 2023, di group target beta companies, including telecommunications firms, tech companies, business outsourcing outfits, cloud communication providers, and plenti virtual currency business dem. Na through “phishing” text message dem take dey enter people computer dem. Buchanan con confession say for April 2023, police jam im computer for Scotland with plenti secret files wey belong to di companies wey dem attack. Im explain say dem dey use di stolen info to enter virtual currency accounts of innocent pipo and empty dia wallet dem.
Before now, di four oda members of dis criminal group don receive dia judgment. Ahmed Elbadawy, wey be 25 years old, collect 45 months for federal prison for September 18. Noah Urban, 22, dey serve 10 years jail term, while Evans Osiebo, 22, wey dey stay for Dallas, Texas, collect 45 months for federal prison for August 14. Di last person, Joel Evans, 27, don begin im own two-year jail term. All of dem don gree say dem guilty of conspiracy to commit wire fraud.
Source: NaijaProbe
